For di first time in history, Saudi Arabia go make dia first appearance for Miss Universe beauty pageant

Saudi Arabia Miss Universe - Figure 1
Photo BBC News

Wia dis foto come from, Getty Images

28 March 2024, 19:45 WAT

New Informate one hour wey don pass

For di first time in history, Saudi Arabia go make dia first appearance for di Miss Universe beauty pageant.

Rumy Alqahtani, a beauty pageant and influencer go be di first woman wey go represent Saudia Arabia for di Miss Universe competition.

Wit dis, e mean say Saudi Arabia go join oda kontris wey go participate for di 2024 Miss Universe wey go happun for Mexico.

Di Miss Universe Organization (MUO) na global, inclusive organization wey dey celebrate all cultures, backgrounds and religions.

Rumy bin announce for her Instagram page say she go participate for di competition to represent her kontri for di first time

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

She bin express her appreciation to be selected for di competition.

Di Miss Universe 2024 go be di 73rd edition of di prestigious pageant and na 18 September 2024 dem go do am.

Di current holder of di Miss Universe wey be from Nicaragua, Sheynnis Palacios, go pass her crown to anoda pesin for di event.

Di first time wey anybody from Nicaragua go dey crowned as Miss Universe na 2023 as Antonia Porsild from Thailand and Moraya Wilson from Australia secure di second and third positions.

Wit di participation of Rumy to represent Saudia Arabia, e go create history for di kontri as dem dey try to diversify dia economy through tourism.

“I dey honoured to participate for di Miss Universe 2024 competition. Dis na di first participation of Saudi Arabia for di Miss Universe competition," di beauty pageant write for her Instagram.

Miss Universe na competition wey dem create to provide 'safe space for women make dem fit share dia stories and drive impact professionally and philanthropically.'

For 2018, Saudi Arabia bin lift di ban say make women fit dey drive for di kontri and dat one make plenti headlines. Dis new historic step go place Saudi Arabia for world stage again as kontri wey dey make efforts towards gender equality.

Dis go also showcase Saudi Arabia as kontri wey invest for entertainment and creative innovation.

Skip Instagram post

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Profile of Rumy Alqahtani

Rumy Alqahtani na regular face for Saudi Arabia beauty space and she no dey new to di spotlight.

She don win plenti beauty contest for international stage as she continue to dey represent Saudi Arabia.

Rumy hail from Riyadh, she be 27-years old and she don win beauty titles wey include Miss Asia and Miss Europe.

For 2021, Rumy first participate for Miss Saudi Arabia, den by 2022, she participate for Miss Arab World Peace to represent Saudi Arabia wit oda contestants. Na she be di Miss Europe Saudi Arabia for 2023, and she dey also hold di title of Miss Middle East.

Rumy get Bachelors degree for Dentistry and she sabi speak about three languages wey include French, English and Arab.