Who be Aanvi Kamdar di Indian influencer wey die while shooting reels

Wia dis foto come from, Aanvi Kamdar Travel and Lifestyle/Threads

Aanvi Kamdar - Figure 1
Photo BBC News

32 minutes wey don pass

Indians for social media dey mourn one of dia influencers wey die on Wednesday.

Indian Police confam say di popular travel influencer for India, Aanvi Kamdar die at di age of 26 years.

Di popular travel influencer Aanvi Kamdar die wen she bin dey shoot video reels for one tourist site wey she visit on Wednesday 17 July, 2024.

Tori be say she fall inside di gorge [di middle of valleys, rocks and mountains] for one waterfalls site wia she bin dey record reels.

According to local media Hindu Times, "di Superintendent of Police Raigad, Somnath Gharge, say Ms. Kamdar bin dey alive afta she fall into a gorge wen she bin dey shoot one video near di Kumbhe waterfalls for di Mangaon district of Raigad on July 17, However, dem bin rescue her but she die during di treatment." Police tok.

How she take die?

Wia dis foto come from, @theglocaljournal/Instagram

Wetin we call dis foto, Late Aanvi Kamdar bin pose for one of her travel destinations.

Tori be say di late Ms Aanvi Kamdar dey live for Mumbai and she like to dey shoot video reels.

Aanvi Kamdar - Figure 2
Photo BBC News

She bin go di waterfalls wit her friends to enjoy di rainy season for di waterfalls.

Na wen she bin dey snap pictures and do videos of di waterfall, her leg slip by mistake and she fall straight inside di 350-foot-deep gorge.

According to Hindu Times, immediately di information about di accident spread, di Sahyadri Wildlife Conservation Society and Mangaon police officers reach di place wit rescue forces sharp sharp.

"Wen we bin dey descend to rescue di woman from di gorge, big stones bin dey fall on us.

At first, e be like say di woman bin no dey alive, but wen we go closer, we see say she still dey breath, wey confam say she bin dey alive.

Dem immediately rush her to hospital but she die during di treatment," Somnath Gharge tok.

Aanvi Kamdar dey trend for India afta police confam her death and Indians don begin mourn her for social media.

Skip Facebook post

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Facebook post

Late Ms Aanvi Kamdar na popular travel and relationship influencer wey based for Mumbai, India. Tori be say she be banker too wey like to travel and visit places.

For social media, she dey popular as 'theglocaljournal'

Few days before her death, di Travel Influencer bin post five destinations wey she go like to visit for her verified Instagram page.

Skip Instagram post

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post