Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dis na di first north London derby for di Premier League dis season

54 minutes wey don pass

Arsenal - Figure 1
Photo BBC News

Tottenham go face Arsenal on Sunday for di first Premier League north London derby of di season.

Dis na evritin you need to know about di ogbonge game.

Team news

Tottenham pair Micky van de Ven and Dominic Solanke fit dey available for di match afta dem recover from knee and ankle injuries.

But Yves Bissouma fit no dey available sake of di groin problem wey im get during im international duty for Mali. Meanwhile Richarlison still dey out.

Arsenal captain Martin Odegaard go do more tests to determine di extent of im ankle problem but im manager Mikel Arteta no rule am out for dis weekend wen im tok to tori pipo on Friday about di game.

Declan Rice go serve a one-match ban and Mikel Merino dey out of di game sake of shoulder injury but Gabriel Jesus dey fit again and di club say dem go check Riccardo Calafiori calf issue again.

Tottenham vs Arsenal prediction

BBC football sabi pesin Chris Sutton and Femi Koleoso, Ife Ogunjobi from jazz band Ezra Collective share dia predictions for di match,

Chris Sutton prediction: Di Gunners go get chances for dis game and I expect dem to score – dem win dis fixture 3-2 last season and draw 2-2 for Emirates, I dey expect more of di same.

Dis time, however, I dey support Spurs. I know everyone go probably go for a draw but I no go do dat. Instead, I go to stick my long neck out and say 'Angeball' go come out on top’.

Spurs don dominate games and create chances dis season, but dem just need somebody to score and I feel say e go happun for dem hia. If I dey correct, den we fit just hand di title to Manchester City.

Sutton prediction: 3-2

Femi wey dey support Arsenal believe say im club go deliver.

Femi prediction: Di last time I do these predictions, na 2021, my brother TJ say Spurs go lose 11-0 to Liverpool, and dat na di only game im get wrong. I dey go for Arsenal win - if Ange play wit a high line again den I get confidence say we go win. Spurs also no dey defend set-pieces well, and we dey good for dat area. 0-3

Ife prediction: As a neutral, I dey for a draw. I wan see how Arsenal midfield go be without Rice and Odegaard. 1-1

Match facts

Head-to-head

Di two clubs don play a total of 195 North London derbies in all competitions, Tottenham don win 61, Arsenal 82 and don play draw 52 times.

Tottenham only victory in di past seven top-flight meetings for dia home happun for May 2022 - di match end 3-0 - oda results na (D1, L5).

Dis fixture don produce di most penalties awarded (26) and scored (24) for Premier League history.

Tottenham Hotspur

For di first time since 2011-12 under Harry Redknapp, Tottenham fit lose more than one of dia opening four matches of a top-flight season.
Dem don lose six out of dia past 10 Premier League fixtures (W3, D1).
Spurs don chop own goal for each of dia last three top-flight meetings wit Arsenal: Hugo Lloris for January 2023, Cristian Romero for September 2023 and Pierre-Emile Hojbjerg for April 2024. No team don ever score own goal in four consecutive Premier League meetings wit an opponent.
Son Heung-min dey one goal away from moving into di top 20 of di all-time leading Premier League goalscorers, wit 122 goals. Dwight Yorke and Raheem Sterling both get 123 and dem sidon togeda for -19th position for di list.

Arsenal

Di Gunners don win nine of dia last 10 away league matches, draw one and keep eight clean sheets. Dem don equal dia longest top-flight away winning streak of five games under Mikel Arteta.
Arsenal eight-game Premier League winning streak bin end against Brighton wen dem play 1-1 for dia home for dia most recent outing.
Bukayo Saka bin score home and away goals against Tottenham for Premier League last season. A goal on Sunday go make am di third Arsenal player to score in three consecutive north London derby appearances, afta Emmanuel Adebayor and Robert Pires.
Raheem Sterling fit become di first Arsenal debutant for north London derby since Isaiah Rankin bin do so for December 1997.
Kai Havertz don dey directly involved in 18 goals for 21 Premier League appearances for 2024, scoring 11 and setting up seven.
David Raya go turn 29 years on di day of dis match.