Wia dis foto come from, Getty Images

1 July 2024, 10:38 WAT

France vs Belgium - Figure 1
Photo BBC News

New Informate one hour wey don pass

Di journey of Belgium for di Euro 2024 don end afta one own goal mistake give France di chance to proceed to di quarter-final.

Dis na very painful exit for Belgium as dem bin hold down dis game wit France till di last five minutes, but unfortunately, one mistake by dia defender make dem crash out.

Kolo Muani get into a comfortable position for front of Belgium goalpost and im shoot from dat yard, sadly, di ball dey deflected by Jan Vertonghen wey cause di own goal.

Wit dis win, France don win three of dia successive games against Belgium aside for penalty shoot-outs.

Na only one game France don lose for dia last 15 Euro game afta winning eight and drawing six.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

Dis match na di first Euro round of 16 games out of eight wey Belgium no go score any goal.

Dis also mean say Belgium neva play any extra time for Euro game- and dem no see dat chance again dis year. And France don play seven extra time out of 14 Euro round of 16 games.

Di game really dey difficult wit di two teams sake of dia strong players but France bin get more opportunities dan Belgium.

Lukaku and im team for hope to sail through but dia journey don end.

France defender Jules Koundé win di Player of di Match sake of im "very strong defense, very helpful for attacking areas, im deliver dangerous crosses and very good one on one defense against Doku."

France go through to quarter-final but Belgium go home. Really tough game of 'go hard or go home.'

Live updates

France 1-0 Belgium

FINAL WHISTLE

Di game is ova. France don through to di quarter-final

90+2mins- YELLOW CARD. Mangala chop card for Belgium

France vs Belgium - Figure 2
Photo BBC News

De Bruyne take di corner, very low one looking for goal.

90+1mins- Doku, im fit make am an equaliser? Oh, saved and blocked to corner.

90mins- Dat na foul against De Ketelaere by Saliba, di referee blow whistle.

3 Mins Added Time

87mins- Di pressure don dey high ontop Belgium head. Dem go fit equalise like dis?

France 1-0 Belgium

85' Kolo Muani score for France but na deflection by Belgium defender. Incredible by di man wey come from di bench now to dey instrumental to di goal.

Belgium defender Vertonghen cause di own goal.

GOOOAAAALLLLL

84mins- Kante dey dis match and im dey play well.

What A Miss for Belgium

82mins- Belgium wit more pressure. straight shot by De Bruyne, oh, dat was blocked by France goalkeeper.

78mins- Mbappe miss dat long shot across di bar.

77mins- France dey shoot from all angle but none of dia shot don enta net.

75' YELLOW CARD- Belgium get first yellow card. Vertonghen chop card sake of di foul against Kolo Muani of France.

74mins- Saliba!!! Dat was a target so close. How im take reach dat position na wonder but den, im no balance to put di ball behind di net.

France 0-0 Belgium

Wia dis foto come from, Getty Images

72mins- Dat na very good save from Maignan. E save France from big loss.

70mins- Lukaku take chance at di goal.

68mins- Chanced Missed!! Tchouameni miss dat chance wey for give France good lead. Im blast di shot ova di bar.

66mins- Griezmann trying to create chances but be like say im effort no reach.

64mins- Upamecano get a Free Kick.

63' SUBSTITUTION- Thuram out, Muani in for France. Openda out, Mangala in for Belgium.

60mins- A chance for Belgium, good run, Maignan dey fear as di ball move closer, oh no, dat was blocked for Belgium.

France vs Belgium - Figure 3
Photo BBC News

Carrasco shot blocked by Hernandez.

58mins- France don get plenti shots for dis game but none don enta di net yet.

56mins- Anoda chance again for Mbappe, im go fit convert am. Oh no, anoda miss target

54mins- Mbappe!!! What a Miss, dat for be France leading goal but Mbappe miss dat target from shooting wide.

52mins- Thuram dey move closer and closer but im miss di target.

50mins- France putting more pressure in dis second half. Be like say dem dey hungry for goal.

48mins- What A Save!!! What A Chance!!!

Casteels save di ball for Belgium, dat was very close to goal. Tchouameni deliva one good shot wey dey deflected.

46mins- Belgium dey defend very well and dia possession dey impressive as dem move to put pressure ontop France.

France 0-0 Belgium

SECOND HALF

Wia dis foto come from, Getty Images

HALF-TIME

FINAL WHISTLE

45+1mins- Di two teams looking for goal to separate dem, but di defenders no gree. Nice chance for France close to di end of first half.

1 Mins Added Time

What a Miss- Tchouameni play long shot wide across di bar.

44mins- Mbappe playing from di side of Belgium post

42mins- Griezmann on di floor afta following di ball from di angle of France box 18.

40mins- Kounde get a through pass but beautifully cleared by di defender.

39mins- Tchouameni miss di target afta firing a long shot at di goalpost of Belgium. Dat na far distance but di attempt make sense.

36mins- Nice Save by Belgium goalkeeper Casteels. Im don save some good balls for di match so far.

35mins- Kounde get free kick for France. Nice run.

33mins- What a powerful header by Thuram, from di angle, but e miss di target for France.

De Bruyne of Belgium dey penalised for foul against Griezmann.

France vs Belgium - Figure 4
Photo BBC News

32mins- Indirect Free Kick for France. Ball in play for France.

France 0-0 Belgium

30mins- Throw-in for France as Doku toss di ball go outside play.

28mins- Belgium moving forward wit di ball, as De Bruyne find im player to pass and create chance for di middle.

26mins- Nice run by Lukaku, im drop di pass to position imsef. oh, shot blocked straight to Carrasco. Nice shot by Carrasco but defenders block am. Hernández block di shot saving France from an early defeat.

24mins- Oh, anoda rough tackle dia by Rabiot. YELLOW CARD, Griezmann chop card.

23' YELLOW CARD- Oh what a poor tackle by Griezmann. E don chop yellow card sake of im foul against Doku of Belgium

21mins- France seem to be possession, wit Kounde driving from di back to di front feeding Griezmann and Mbappe wit passes. Oh, beautiful skill by Mbappe dia

19mins- Lukaku get nice move, driving through to di France 18 yard box, but e no complete am well.

18mins- Anoda effort for France, but again na off target oooo as Thuram head am go wide position from corner.

16mins- Griezmann take di corner for France. beautiful position but Belgium defenders dey kampe, dem no shake.

14' YELLOW CARD- Tchouameni chop yellow card for shouting at di referee

Nice Try, Mbappe take a chance at di target but e miss am.

Corner for France. Griezmann step in to take di kick. A short one..

12mins- Griezmann still dey find im first goal for dis tournament.

11mins- Di ball dey back in play wit Mbappe trying some skills. Griezman get a touch wit a pass. Oh, no France player to complete dat goal

Goalkeeper Casteels make good save for Belgium.

10mins- Griezmann wit di ball, driving through for a chance at di goal. Oh, what a nice save.

6mins- Mbappé get some good touch. Im be two-time champions.

Onana step forward to take di indirect free-kick for Belgium.

4mins- Nice touch from Thuram of France but e dey offside position, referee blow whistle.

Rabiot miss di target.

2mins- France possession dey well set. Rabiot volley di ball from an angle to di Belgium side. Dat na safe attempt.

0mins- Dis game come wit plenti pressure as di two team dey hope to advance to di next stage

France 0-0 Belgium-

FIRST HALF

Wia dis foto come from, Reuters/PA

Team squad

Belgium First IX: Casteels Theate Faes, Vertonghen, De Bruyne, Lukaku, Carrasco, Openda, Castagne, Doku, Onana

France First IX: Maignan, Upamecano, Koundé, Griezmann, Tchouameni, Mbappé, Kanté, Rabiot, M. Thuram, Saliba, T. Hernández

Match Stats

Dis na di 76th meeting betwin France and Belgium. Di match start by 5pm Nigerian time.

France bin don win all four of dia matches wit Belgium for a major tournament. Di most recent na di 1-0 victory for 2018 World Cup semi-final.

Di last time dem meet for Euros na 40 years ago, for 1984 - France bin win 5-0 for di group stage.

France bin don score only two goals for di Euro 2024 group stage, and na di fewest goal dem don score for di group stage of a major tournament since di 2010 World Cup.

Belgium don reach di knockout stages of a Euros tournament for di third consecutive time, and dem don win dia last four last-16 games for a major tournaments.