Manchester City 2-2 Arsenal

Wia dis foto come from, Getty Images

Man City vs Arsenal - Figure 1
Photo BBC News
Wetin we call dis foto, Arsenal celebrate goal wey Riccardo Calafiori score

22 September 2024, 15:22 WAT

New Informate 2 hours wey don pass

Second Half

Full Time Manchester City 2-2 Arsenal

90+8 Referee blow whistle match don end

Manchester City 2-2 Arsenal

90+7 GOAL!!! Manchester City score!!!! John Stones bury di ball inside net!

90+7 Last attack attempt for Manchester City wey dey under pressur!

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

90+6 Phil Foden of Manchester City fire shot from di edge of di box Arsenal goalkeeper save am wit confidenc.

90+2 Substitution fir Arsenal Myles Lewis-Skelly don enta to replace Jurrien Timber wey injure.

90+1 Bernardo Silva of Manchester City collect yellow card.

90+1 Jurrien Timber dey down wit injury and referee stop di match so dat im fit get treatment.

90+1 Referee add 7 minutes

87’ Substitution for Arsenal, Gabriel Martinelli don replace Gabriel Jesus.

87’ Big chance for Manchester City but Josko Gvardiol waste di opportunit. E fire shot from mid range towards di bottom left corner, David Raya save am again!

85’ Manchester City dey mount pressure on Arsenal defence but David Rays na dia nemesis today.

84’ Manuel Akanji of Manchester City send beta cross into di area but David Raya Arsenal goalkeeper block di ball.

83’ Declan Rice of Arsenal collect yellow card as e try to delay di match.

82’ Mateo Kovacic of Manchester City make one strong challenge Referee blow whistle for foul and Arsenal get free kick.

80’ Manchester City dey under serious pressure! Mateo Kovacic shot no go well as im effort fly over di bar!

78’ Substitutio for Manchester City as Guardiola bring in Jack Grealish to replace Savinho.

78’ Sunstitution for Manchester City, Kyle Walker don comot and John Stones don enta.

78’ Phil Foden of Manchester City fire shot too but I’m effort go over do bar. Manchester City dey under pressure to score!.

Man City vs Arsenal - Figure 2
Photo BBC News

77’ Erling Haaland of Manchester City fire beta shot but defender block am.

76’ David Raya Arsenal goalkeeper save beat long range effort from Ruben Dias of Manchester City near di middle of goal post.

74’ Substitution, Riccardo Calafiori of Arsenal no go fit kontinu wit di match sake of injury. Jakub Kiwior don replace am.

72’ Ruben Dias of Manchester City collect one beta pass, im strike di ball from outside but dem block im shot.

70’ Freekick for Arsenal afta Ruben Dias of Manchester City challenge im opponent badl, Referee blow whistle for foul.

69’ Substitution for Manchester City, Phil Foden don enta to replace Jeremy Doku.

66’ David Raya of Arsenal wey bin dey take medical attention don dey okay now.

65’ Myles Lewis-Skelly of Arsenal don collect yellow card for yeye behaviour.

62’ Josko Gvardiol of Manchester City dey beta position na di first pesin to get do bal wey bounce back, im fire a low shot towards di middle of goal but David Raya save so ball.

61’ Kyle Walker of Manchester City control one pass from di edge of di box e fire shot towards goal but defender block and clear di ball.

59’ Erling Haaland of Manchester City escape di pesin wey dey mark am to connect wit one beta cross , im nod am very low towards di right side of goal, but di goalkeeper save am!

59’ Manchester City play short corner kick as dem pass di ball to a nearby teammate.

57’ Kyle Walker of Manchester City fire one beta shot di ball go towards di right post but David Raya save am.

57’ Manuel Akanji of Manchester City fire one shot at goal from beta position outside di penalty area but defender block am.

56’ Corner kick for Manchester City, Jeremy Dokubplay am but na short corner kick e play.

55’ Savinho of Manchester City collect one pass from di edge of di box e fire beta shot but defender block am.

53’ Bernardo Silva find Ruben Dias of Manchester City afta a very hard work, but e shoot im attempt from di edge of di box out of play.

Man City vs Arsenal - Figure 3
Photo BBC News

52’ Bernardo Silva of Manchester City send in one cross from free kick from di corner of di box but di ball go out of pla.

50’ Mateo Kovacic of Manchester City send beta pass into di box near Savinho, im dribble im try to dribble opponent but im no succeed. Dem clear di ball.

48’ Erling Haaland of Manchester City raise im head to nod one cross towards di left corner but di ball no go wia e wan place am David Rays save am.

47’ Kai Havertz of Arsenal don commit foul and referee blow whistl.

47’ Kyle Walker of Manchester City pass ball from a very tight place into di box for Bernardo Silva but David Raya stop am.

46’ Substitution for Arsenal, Ben White enta to replace Bukayo Saka

46’ Referee don low whistle and second half don start.

First Half

45+10' First half don end

45+8' Leandro Trossard of Arsenal collect anoda yellow card and Referee show am RED CARD !

45+7' Yellow card for Thomas Partey of Arsenal

45+2' Referee say NO FOUL!

45+2' Referee go check VAR to review di goal to check if foul happun.

45+1 Ruben Dias of Manchester City collect yellow card.

45+1 Manchester City 1-2 Arsenal

45+1 GOAL!!! Arsenal score dia second goal as Gabriel fire di ball inside di net.

45' Referee add 6 minutes.

44' David Raya block one long pass from Savinho of Manchester City.

43' Arsenal dey offside.

42' Gabrielle Martinelli of Arsenal play one pass enta Leandro Trosard leg, im effor go over di bar!.

38' Bukayo Saka of Arsenal play di corner kick but notin come out.

37' Bukayo Saka of Arsenal break free but Manchester City player clear di ball. Arsenal ger corner kick.

36' Corner kick for Manchester City, Savinho play am but e land for di head of dia opponent.

34' Leandro Trossard of Arsenal collect yellow card afta a very bad tackle on im opponent.

30' Kyle Walker of Manchester City play one long range ball afta e collect pass, e direct di ball toawards di left post, goalkeeper save am.

Man City vs Arsenal - Figure 4
Photo BBC News

28' Kai Havertz of Arsenal bring down im opponent , referee blow whistle for foul. 24' Jeremy Doku of Manchester City get half chance to score but e pass di ball into di box.

22' Ederson of Manchester City chop yellow card sake of di way e tok to referee.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Manchester City celebrate dia first goal against Arsenal for di match

22' Manchester City 1-1 Arsenal

22' GOAL for Arsenal !!!! Riccardo Calafiori score from Gabriel Martinelli pass.

21' Substitution for Manchester City, Mateo Kovacic don replace Rodri sake of di injury.16' Rodri of Manchester City dey ground wit injury, we neva know if im go fit kontinu wit di match.

15'Beta shot wey IIkay Gundogan of Manchester City playas freekick shake di right post.

12'Referee blow foul aftaafta Gabriel of Arsenal gve im opponet bad tackle.

12' Erling Haaland make one bad challenge and referee blow whistle for foul.11' Bukayo Saka of Arsenal waste good chance as dem block di ball wey im pass into di box.

9' GOAL! Haaland don score as Mancity take di lead.

3mins: Rodri dey for ground afta slight foul by Havertz

Man City 0-0 Arsenal

1min: KICK OFF

Wia dis foto come from, Getty Images

Premier League defending Champions, Manchester City don ready to face Arsenal on Sunday evening for di Etihad Stadium.

Manchester City don win all dia league matches dis season while Arsenal draw one match.

Football fans dey wait to see who go outplay each oda for dia first Premier League meeting dis season.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Erling Haaland, Manchester City/ Raheem Sterling, Arsenal

Wia dis foto come from, Getty Images

Team news

Manchester City midfielder Kevin De Bruyne fit play di match even though dem force am comot for half-time against Inter Milan on Wednesday.

Man City vs Arsenal - Figure 5
Photo BBC News

Nathan Ake and Oscar Bobb no go play.

Arsenal welcome Declan Rice to Premier League football afta im bin miss di win over Tottenham last weekend sake of suspension.

Midfielders Martin Odegaard and Mikel Merino still dey out, along wit defenders Kieran Tierney, Takehiro Tomiyasu and Oleksandr Zinchenko.

Match facts

Head-to-head

Manchester City dey unbeaten for nine home league games against Arsenal since dia 2-0 defeat for January 2015 (W7, D2).

Di four points Arsenal bin win against City last season na double di amount dem manage across dia previous 15 top-flight meetings.

Di Gunners bin keep clean sheet for two league encounters wit City last season, dem concede at least once for dia previous16 clashes.

Na Rob Holding bin score Arsenal only goal for dia last six visits to di Etihad and na 4-1 defeat for April 2023.

Arsenal win 99 of di 211 meetings for all competitions (D47, L65). In dia history dem don only record100 wins against Everton, while na di most defeats City don get against any opponent.

Manchester City

Manchester City dey hope to become di first team in English top-flight history to win dia opening five league matches in five seasons.

City win 13 consecutive top-flight games since dia 0-0 home draw against Arsenal on 31 March.

Dem dey on a club record run of 47 successive home matches unbeaten for all competitions since dia 2-1 defeat against Brentford in November 2022.

Pep Guardiola bin don only win more fixtures as Manchester City manager against Burnley (17) dan versus Arsenal (16).

City don equal dia longest run of consecutive Premier League home matches witout a clean sheet under Guardiola of six.

Erling Haaland tally of nine goals for di opening four league games dis season na di most by a top-flight player since 1951-52 wen Jack Rowley bin also score nine in four matches for Manchester United.

Di fewest appearances any player don take to reach double figures for di Premier League campaign na six, by Mick Quinn for 1992-93 and Haaland imsef for 2022-23.

Haaland dey aim to becom only di second player afta Luis Suarez for December 2013 to score multiple goals in four consecutive Premier League appearances.

Im don score more Premier League goals dis season dan any of di oda 19 top-flight clubs.

Arsenal

Arsenal bin win six consecutive Premier League away games since drawing 0-0 for Manchester City on 31 March.

Di Gunners fit becom di first side for Premier League history to go 12 successive matches without coming from behind in an away match.

Dem bin keep clean sheet for nine of dia past 10 away league fixtures.

However, Arsenal get only won three of dia 29 Premier League away matches against di reigning champions.

Since di start of last season, Mikel Arteta side score an unrivalled 24 top-flight goals from set pieces, minus penalties.

Arteta don lose nine competitive matches as a manager against City, three more dan im get versus any oda opponent.

Im dey aim to becom only di second coach afta Ole Gunnar Solskjaer for Manchester United to keep three consecutive top-flight clean sheets against a team wey Pep Guardiola dey coach.

Bukayo Saka fit becom only di second player aftaThierry Henry for 2004-05 to provide an assist for each of a team first five Premier League matches to a season.