Matt Gaetz: Donald Trump attorney general choice send strong ...
Why Matt Gaetz wey be Donald Trump choice for attorney general shock pipo
Wia dis foto come from, Getty Images
14 November 2024, 09:23 WAT
New Informate one hour wey don pass
Donald Trump nomination and announcement of Congressman Matt Gaetz to be im attorney general sound very loud for Washington DC on Wednesday.
Of all di picks wey di president-elect don make for im administration so far, dis one na easily di most controversial one. E send clear message say Trump wan shake tins wen e return to power.
Di firebrand Florida politician dey most popular for being di pesin wey ginger di work to comot di den Republican Speaker of di House Kevin McCarthy last year.
For social media post, Trump tok how e wan use Matt Gaetz like wrecking ball to take radically change di US Department of Justice wey im say na di reason for all im plenti legal wahala.
Why Matt Gaetz nomination come as shock?
Gaetz get history of being in di middle of controversies for Congress.
For 2018, e carri right-wing Holocaust denier enta di State of di Union, and later try to pursue two papa wey dia pikin die inside mass shooting from one hearing afta dem bin object to a claim wey e bin make on top gun control.
Im bombastic approach mean say im get plenti enemies even di one for inside im own party. So, Trump choice of Gaetz dey show those Republicans say im second administration go dey full of loyalists wey im trust to go wit im agenda weda conventional political opinions like am or not.
Axios report say pipo shout during one meeting of Republican lawmakers wen du nomination for America top US prosecutor bin dey announced, axios report cite sources wey bin dey di room.
Tori be say Republican Congressman Mike Simpson of Idaho bin swear wen e hear am.
Alaska Republican Senator Lisa Murkowski tok say, "I no tink say na serious nomination for di attorney general. Dis one no dey my Bingo card."
Gaetz sha get some padi-padi for Capitol Hill wey dey share dat kain loyalty to Trump. Di Florida lawmaker na one of di president elect most gingered defenders, weda na for congressional hearings, for press conferences and for television appearances.
On Wednesday, di House Speaker Mike Johnson wey be anoda devoted Trump loyalist call Gaetz say e be “accomplished attorney”.
Johnson tok say, “e be reformer for im mind and heart, and I tink say e go bring a lot to di table on dat mata”.
Trump don tok say, “Matt go root out di systemic corruption for DOJ, and e go return di department to dia true work wey be to fight crime and uphold our democracy and constitution”.
For di campaign, Trump bin promise punishments for di plenti investigation against am. Now e be like say Gaetz go dey in front of Trump efforts to chook eye for di justice department.
Di department bin don already investigate Gaetz gan-gan.
Last year, dem bin decide say dem no go charge am on top accuse say e go against di sex trafficking laws for one trip wey e go Bahamas wit paid escorts. E bin dey one ethics investigation for di House of Representatives on top accuse of sexual misconduct, illicit drug use and misuse of campaign funds.
But for Wednesday evening, Johnson tok say Gaetz don resign as lawmaker, wey mean say di House investigation on am don finish bicos di committee dey only investigate members.
Gaetz don deny all di accusations against am.
According to CBS News, Gaetz bin don ask Trump for pre-emptive pardon for any crimes from bifor di president comot from office for January 2021.
All dis kain tin na im be why im choice for dis office wey dey normally go to senior politicians wey get more knowledge of di law, shock pipo.
Gaetz, 42 get law degree and bin work for one Florida law firm bifor im go spend eight years for Congress. Joe Biden attorney general Merrick Garland na former senior federal appellate court judge. Even Trump for im first term bin pick US Senator Jeff Sessions and later Bill Barr wey bin get years of experience for Republican presidential administrations.
Na di Senate las-las go fit confam Gaetz nomination and di Florida congressman don vex some pipo for dat chamber wey include Republicans. So even though im party get majority, na just four "no" votes togeda wit unified Democratic opposition e go take to sink im chances to get di job.
Gaetz imself tok last year say e go love to be attorney general while acknowledging say e dey very unlikely.
“Di world never ready, probably,” e tell Newsmax for one interview. “Certainly Senate confirmation no go happun, but you know, a boy fit dream.”
For di moment, however, Trump closest supporters dey celebrat pick.
“The hammer of justice dey come,” Elon Musk post about Gaetz on X.
Regardless of di ultimate outcome of Gaetz bid to be attorney general, Trump don fire a warning shot across di bow of US government. While im second term in office fit dey more organised dan im first, e fit end up being even more confrontational.