Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Samu Aghehowa celebrate as e give FC Porto do lead.

3 October 2024, 17:43 WAT

Porto vs Man United - Figure 1
Photo BBC News

New Informate 14 minutes wey don pass

Full time FC Porto 3-3 Manchester United

90+6 Match don end

90+2 Substitution for FC Porto Danny Namaso don enta for Alan Varela.

90+1 Harry Maguire try reach di and of di corner kick wey Manchester United bin get, im head di ball from around di penalty spot into di bottom left corner of di post.

90+1 GOAL! for Manchester United

90’ FI’ve minutes added time.

89’ Christian Eriksen of Manchester United launch si ball from one corner but one of di defenders clear di ball.

86’ Alejandro Garnacho of Manchester United try to create one dangerous situation in front of goal as im cross ball into di box but defenders clear am.

85’ Manchester United dey do short short passes to try create chance to attack.

81’ Bruno Fernandes don collect Red card wey result from two yellow cards for dis match.

81‘ RED CARD! for Manchester United!

79‘ Substitution for Manchester United, Jonny Evans don enta for Matthijs de Ligt.

78’ Anoda substitution for FC Porto Joao Mario don comot and Deniz Gui replace am.

77’ Double substitution for FC Porto Samu Aghehowa don comot and Marko Grujic replace am. Stephen Eustaquio comot too and Fabio Veira enta

77’ Noussair Mazraoui of Manchester United make one slide but referee blow whistle for foul.

75’ Anthony of Manchester United play beta cross into di penalty area but opposition defender clear di danger.

Porto vs Man United - Figure 2
Photo BBC News

73’ Bruno Fernandes play so corner kick wey come out from im shot but notin come out.

71’ Bruno Fermandes of Manches Unite create space for imsef to collect pass from di edge of di box, e fire shot but e go over di bar!!

68’ Anoda change for Manchester United, Amad Diallo dey comot Anthony don enta.

68’ Substitution for Manchester United, Joshua Zirkee don enta im replace Rasmus Holjund

68’ Diogo Dalot send pass into di box but opposition clear am.

66’ Corner kick for Manchester United, Bruno Fernandes play am but e enta defenders leg.

64’ Substitution for FC Porto, Pepe don play finish and Aghehowa replace am

57’ FC Porto dey enjoy possession of di ball, dem dey try create chance to attack Manchester United!

52’ Chance! Diogo Dalot of Manchester United play one pass into di box but Diogo Costa save am.

50’ Samu Aghehowa of FC Porto get beta pass from Pepe and im arrange imsef well as im fire di ball di di right top corner of di post.

50’ GOAL! FC Porto don score!

46’ Substitution for Manchester United Marcos Rashford don comot Garnacho don enta.

48’ FC Porta waste dia corner kick as notin come out.

48’ Sole effort from Nehuen Perez of FC Porto. Im carry di ball run reach wia goalkeeper dey, im play di ball to di bottom right corner but Andre Onana save di ball.

46’ Second half don start

Porto vs Man United - Figure 3
Photo BBC News

Second half

Wia dis foto come from, Getty Images

First half

Half time FC Porto 2-2 Manchester United

45+4 First half don end.

45’ Referee add 3 minutes.

44’ Bruno Fernandes of Manchester United play corner kick but di ball land for di head of im opponent.

43’ Casemiro of Manchester United meet one pass inside di box, im play very low shot to di middle of goal but Diogo Costa save am.

38’ Bruno Fernandes of Manchester United collect one beta ball into di box, im dey go meet Lisandro Martinez but im no fit reach di end of di pass.

34’ Samu Aghehowa of FC Porto score di equalizer as im jump to meet one beta cross, im head di ball into di roof of di net.

34’ GOAL! for FC Porto

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Manchester United celebrate goal

31’ Bruno Fernandes of Manches united collect im on yellow card.

31’ Sami Omorodion of FC Porto don collect yellow card.

31’ Diogo Dalot of Manchester United carelessly slide enta di feet of im opponent but referee blow whistle for foul.

Porto 1-2 Manchester United

27’ Pepe score for Porto afta im get ball wey bounce back inside di box wit im head, im manage to put di ball for di bottom right corner of di post.

27’ GOAL! for Porto

Porto 0-2 Manchester United

20’ Rasmu Hojlund score from an impossible angle but im manage find di back of di net wit shot wey pass di goal keepe.

Porto vs Man United - Figure 4
Photo BBC News

20’ GOAL! Manchester United double dia lead

19’ Opposition clear di corner kick wey Bruno Fernandes of Manchester United.

17’ Marcus Rashford of Manchester United make attempt to find Rasmus Hojlund but di pressure on di ball too much.

Wia dis foto come from, Getty Images

15’ Samu Omorodion of FC Porto try to find Rasmus Hojlund, but im put too much pressure on di ball and waste di chance.

13’ Defenders block FC Porto corner kick.

10’ Pepe fire do ball but im attempt no reach im teammates.

Porto 0-1 Manchester United

7’ Beta individual effort from Marcus Rashford end wit beta strike from inside di penalty area. Im send di ball to di bottom left corner.

7’ GOAL! Manchester United do score!

3’ FC Porto get chance to score from corner kick but defender clear di ball.

1’ Match don start

Portugal club FC Porto go jam Manchester United for matchday two of di Europa league match on Thursday.

Di Portuguese giants go welcome Manchester United to di Do Dragão stadium.

Even though di Red devils collect wotowoto for dia Premier League match against Tottenham over di weekend, and Manager Erik ten Hag leg dey shake for di club, dem still get hope to bounce back.

Di two coaches dey tok tough ahead of di match.

Head to head

According to Uefa Porto and Manchester United don meet six times.

Inside dis six times, Porto win 1, Manchester United win 2 and dem draw three times.

Porto score five goals for all dia meetings while Manchester United score nine goals.

Di first time dem meet na for di 1996/1997 season of di Champions League Quarter-Finals first leg, Manchester United beat Porto 4-0 for Old Trafford.

Di last time dem meet na for di same Quarter-Finals stage of di Champions League, di 2008/2009 season.

For dat match Porto lose 0-1 to Manchester United.

Line-ups

FC Porto starting 11: Diogo Costa, João Mário, Zé Pedro, Nehuen, Moura, Alan Varela, Eustáquio, Nico, Pepe, Galeno, Samu.

Manchester United starting 11: Onana; Mazraoui, De Ligt, Martinez, Dalot; Casemiro, Eriksen; Amad, Fernandes, Rashford; Hojlund.