Elise Stefanik and Tom Homan: US president-elect Donal Trump ...
Trump make two fresh appointments as Elise Stefanik and Tom Homan join Susie Wiles
Wia dis foto come from, Getty Images
22 minutes wey don pass
US President-elect Donald Trump don make two more key appointments ahead of im return to di White House for January 2025.
Tom Homan wey be 62yrs go serve as Trump "border tsar", as e don previously serve as di returning president acting director of Immigration and Customs Enforcement (Ice).
Trump also appoint New York Congresswoman Elise Stefanik wey be 40yrs.
Stefanik collect appointment as ambassador to di United Nations, according to wetin BBC US partner CBS News confam.
Meanwhile, Trump Republican Party dey closer to full control of di US Congress. Dem don alreadi get a majority for di Senate and need to win just some seats to take di House of Representatives.
To win House majority, a party gatz win 218 seats. Di Republicans get 215 compared to di rival Democrats wey get 210, according to CBS.
Control of di House go give a party di power to start spending legislation and begin impeachment proceedings against officials.
If Trump get majority for di House, di lower chamber of Congress, alongside di Senate, di upper chamber, e go give am greater chance to get im plans approved dan if Democrats dey control one or both.
In di meantime, attention don switch to who e appoint to serve for im administration.
For one post for im Truth Social platform, Trump say Homan go be "in charge of our Nation Borders (“The Border Czar”), including, but not limited to, di Southern Border, di Northern Border, all Maritime, and Aviation Security".
E kontinu: "Likewise, Tom Homan go dey in charge of all Deportation of Illegal Aliens back to dia Kontri of Origin. Congratulations to Tom. I no get doubt say e go do a fantastic, and long awaited for, job."
One of Trump major campaign pledges na to deport immigrants wey dey for di US illegally.
A senior source close to Trump transition tell CBS News say Trump don pick Stefanik for ambassador to di UN, and Stefanik accept di role.
"I dey honoured to nominate Chairwoman Elise Stefanik to serve for my Cabinet as US Ambassador to di United Nations," Trump tok shortly afta im statement to CBS News.
"Elise na incredibly strong, tough, and smart America First fighter."
She confam her acceptance of di role to di New York Post, saying she dey "truly honoured".
"During my conversation wit President Trump, I share how deeply humbled I dey to accept im nomination and say I dey look forward to earning di support of my colleagues for di United States Senate," she say.
Who fit dey Trump cabinet
Oda names for di running to join di administration na billionaire X owner Elon Musk, wey play a key role for Trump campaign, and also Robert F Kennedy Jr wey run im own presidential campaign bifor endorsing Trump.
E even get speculation say Florida Senator Rick Scott fit dey in line to become Senate majority leader, afta e receive di backing of Musk and odas.
Trump tok say Nikki Haley and Mike Pompeo wey don serve for im first administration n go get new positions.
Who be Tom Homan?
Wia dis foto come from, Reuters
Trump don confam say Homan go get a wide-ranging role to oversee border security and deportation policy wey be two of im main campaign issues.
Homan na former police officer wey dey also play important role for Trump first presidency as di acting director of Immigration and Customs Enforcement (Ice).
E resign for 2018 but remain for Trump hard-line approach. E support to separate migrant children from dia parents as a means to stop illegal crossings, and say politicians wey dey support migrant sanctuary policies go chop charging wit crimes.
Homan na visiting fellow for di Heritage Foundation - a conservative think-tank wey publish di Project 2025 document, wey set out a "wish list" for a second Trump presidency.
Trump don distance imself from di organisation.
Who be Elise Stefanik?
Wia dis foto come from, Reuters
Stefanik become di youngest woman eva wey dey elected to Congress for 2014, wen she be 30. She kontinue to represent New York 21st District.
Afta she enta politics, di fourth-ranking House Republican bin position herself as a moderate and criticise Trump - but later become im loyal defender.
For im statement to di New York Post, Trump describe her as "an incredibly strong, tough, and smart America First fighter".
Di UN ambassador role dey crucial to global cooperation and security, and Stefanik nomination come as conflicts kontinue to spread for Ukraine and di Middle East.